LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
One Federal High Court wey dey inside Lagos don nak 20 Ghana fishermen jail sentence as after dem plead guilty to drug trafficking
Each one of de 20 pipo bag one year jail term as authorities catch dem say dem move 13.670 kilogrammes of marijuana, aka cannabis sativa, from Ghana enter Nigeria.
Police officers wey wound female LASTMA officer don land for jail
Justice Nicholas Oweibo convict and sentence de 20 men after dem plead guilty on de charges of conspiracy and unlawful transportation of de drug.
De fishermen names na Francis Teye, Kweke Komel, Gad Adjah, Theophilus Tetteh, Kwesi Aboagye, Ekon Fynn, Kwamena Baah, Kwabina Adjei, Micheal Okutu, Isaac Kofi, Kweku Moko, Kwezi Adzi and Kweku Mensah, Micheal Kofi, Ekon Bentum, Kwesi Amissah, Joshua Huago, Otu Otipeseku, Isaac Yorsson and Nana Kodwo.
Dem appear before Justice Nicholas Oweibo after authorities arrest dem with de drug wey dem carry enter Naija from dia country via water on January 14, 2022.
The prosecutor, Mr Fingere Owen, tell court say de punishment na based on sections 11(b) and 14(b) of the National Drug Law Enforcement Agency Act Cap. N30, Laws of the Federation of Nigeria 2004.
After dem plead guilty, de prosecutor review de case again and also him present exhibits and him tell de court make dem sentence dem based on de section of de law wey dey take care of mata like dat but de lawyers to de convicts, Mr Uche Okoronkwo, wey lead Calistus Onyewueke, both of which na from Minerva Legal Practice, tell de court say na de first time wey de 20 men dey offend be dis as dem no get previous criminal records.
Okoronkwo tell de court say him clients na just fishermen wey no sabi wetin dey de bag wey pesin give dem and na like so dem take enter wahala.
Justice Oweibo sentenced them to one-year imprisonment each and dia sentence go start from de date of dia arrest.
For similar news, de National Drug Law Enforcement Agency don announce say dem don bust two major secret drug lab for Lagos and Anambra States, where dem dey cook de dangerous drug crystal methamphetamine ‘Mkpuru Mmiri’.
De agency say after Mkpurummiri become popular due to abuse around de last quarter of 2021 especially for South East and after many communities begin cry out for help around de area, dem use everything wey dem get for de area to take find where de major source dey come from and arrest pipo wey dey behind am as e dey necessary to cut off de source because of wetin e dey do de young ones wey be say na dem dey take am pass.
De Chairman of NDLEA, Brig. Gen. Mohammed Buba Marwa (retd.) announce de breakthrough for one press conference in Abuja.
According to him na all de efforts wey dem put in for de past seven months against de cartel wey dey behind de drug production na wetin lead to de arrest of four of de baron.
As e talk am;
“Now, we have added two barons and another cook. This no doubt is a loud statement to those involved in the criminal illicit drug trade that it’s time for them to quit or risk losing it all; that is, losing their freedom, investment and assets acquired through proceeds from the illegal business. I am pleased to inform the public today that, after months of painstaking intelligence gathering, diligent tracking and coordinated offensive action, we recorded a breakthrough on Saturday, July 30, 2022, when officers and men of the agency successfully busted two methamphetamine manufacturing facilities, called Meth Laboratories.”