• About
  • Contact
  • Privacy Policy
No Result
View All Result
  • Login
Amebo Update
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
No Result
View All Result
Ameboupdate
No Result
View All Result
Home Celebrity

I enter deep depression after i nak my therapist – Omah Lay

The Nigerian singer share him life experience with fans on Twitter

by Pidgin Parrot
July 18, 2022
Reading Time: 3 mins read
0
I enter deep depression after i nak my therapist - Omah Lay
326
SHARES
2.5k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING

CLICK HERE

I enter deep depression after i nak my therapist - Omah Lay

Musician Omah Lay enter Twitter Monday morning where e share some kind secret with him fans as e explain de inspiration behind him new album

Born as Omah Stanley Didia, de Naija music head share how he take struggle with depression as he dey record him recent album Boy Alone wey drop few days ago.

Omah Lay – Never Forget

According to wetin he talk, he say;

“I wanna spill my heart on this app like this like this”

“Boy Alone might be the last time y’all will hear me cry on a song, On G I was dead ass down, insecure, scared, depressed, loosing my mind like I was literally gonna kill myself”

He say the mata worse after he knack de therapist wey dey help am heal

“My depression became worse after I knack my therapist”

“People I use to look up to stoped showing me love, i looked at people in the eye and saw doubt, disrespect and hate on G I lost myself, maybe I was just overthinking I don’t know”

“My babe serve me breakfast for midnight I wan craze”

“I felt like I lost it until After I finished recording Boy Alone, I listened to myself and realized I’m one of the hardest shittt African music have ever seen!!”

I wanna spill my heart on this app like this like this

— Omah Lay (@Omah_Lay) July 18, 2022

Boy Alone might be the last time y’all will hear me cry on a song, On G I was dead ass down, insecure, scared, depressed, loosing my mind like I was literally gonna kill myself

— Omah Lay (@Omah_Lay) July 18, 2022

My depression became worse after I knack my therapist

— Omah Lay (@Omah_Lay) July 18, 2022

People I use to look up to stoped showing me love, i looked at people in the eye and saw doubt, disrespect and hate on G I lost myself, maybe I was just overthinking I don’t know

— Omah Lay (@Omah_Lay) July 18, 2022

My babe serve me breakfast for midnight I wan craze

— Omah Lay (@Omah_Lay) July 18, 2022

I felt like I lost it until After I finished recording Boy Alone, I listened to myself and realized I’m one of the hardest shittt African music have ever seen!!

— Omah Lay (@Omah_Lay) July 18, 2022

Omah Lay Boy Alone album drop on July 15th 2022 and songs from de 14 track album don dey find dia way enter different chart.

Briefly, dem born Omah Lay as Stanley Omah Didia and na for Port Harcourt, Nigeria dem born am in 1997. He enter Naija music mainstream after he drop Bad Influence wey him also produce.

Omah Lay come from Ikwerre Local Government Area for Rivers State. Him go Comprehensive High School for Rivers too before him gain admission to University of Port Harcourt.

He get music background as him grandfather been dey play instrument for singer Celestine Ukwu before him die in 1977 and him papa dey play drum.

Omah Lay start him music career when he join one rap group under de stage name “Lil King.” Him later move on as he begin write songs and produce. For April 2019 him release “Do Not Disturb” then “Hello Brother” after one month.

On 14 February 2020, Lay release “You,” and dat na him first official single. He later drop five-track debut EP, Get Layd on 22 May 2020. The EP enter number one for de Nigerian Apple Music charts. All de five songs from de EP reach top 15 of Apple Music charts for Nigeria, as “You” dey number one.

 

Tags: albumBoy AloneOmah Lay
Previous Post

APGA legal adviser don join Peter Obi campaign

Next Post

Cultism: Police to investigate Portable

Pidgin Parrot

Pidgin Parrot

Next Post
Cultism: Police to investigate Portable

Cultism: Police to investigate Portable

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No Result
View All Result

Categories

  • BBNaija (33)
  • Celebrity (251)
  • Culture (9)
  • Fashion (2)
  • Food (1)
  • Health (20)
  • Lifestyle (67)
  • Music (27)
  • News (633)
  • Travel (25)
  • Uncategorized (21)

Recent.

Gunmen attack Taraba Catholic church

Gunmen attack Taraba Catholic church

August 15, 2022
Former Ondo governor Mimiko don meet Peter Obi

Former Ondo governor Mimiko don meet Peter Obi

August 11, 2022
Herdsmen kill six pipo for Benue

Herdsmen kill six pipo for Benue

August 11, 2022

For all the better totori wey dey we entertainment, music and other gbedu wey dey burst brain.

  • About
  • Contact
  • Privacy Policy

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

No Result
View All Result
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In