LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Ayo Ibrahim ‘Wizkid’ Balogun wey we sabi wella as Wizkid, Naija artist, singer and songwriter wey don win awards turn 32 years today
Fans around de world enter different social media go wish am happy birthday as today na him day and as e dey hot he gaz celebrate himself plus achievements through de years.
Wizkid don tok say he go dey show him fans plenty love without shakara
On top twitter de hashtag Big 32 begin trend as pipo wey dey wish am happy birthday continue to tweet dia well wishes.
Some of de fans wey tweet say;
‘Happy Big 32 @wizkidayo you are my joy giver, my mentor. Love you die man. I am your biggest fan. Tonight I am going to stream all your albums from Superstar to MIL to celebrate you. #WizkidAt32‘
Happy Big 32 @wizkidayo you are my joy giver, my mentor. Love you die man. I am your biggest fan. Tonight I am going to stream all your albums from Superstar to MIL to celebrate you. #WizkidAt32 pic.twitter.com/NRSJH1aKW4
— Good Speed🤞🤞 (@Goodspe68677965) July 16, 2022
‘Happy birthday to one of the greatest to ever do it. Keep inspiring the young generati. Small but mighty! Big Wiz. Big 32′
Happy birthday to one of the greatest to ever do it. Keep inspiring the young generation❤. Small but mighty! Big Wiz💯🙌🏼💖. Big 32🎂 pic.twitter.com/GUMROc6Lci
— Reece James' Bae💙 (@CFCAbake) July 16, 2022
Here na de list of Wizkid babymama and dia children
1. Shola Ogudu

Shola Ogudu na Wizkid first babymama and de journey to motherhood begin one year after dem meet for 2010. Shola born Boluwatife Balogun in 2011 for Wizkid and she dey 19 years when e happen.
At first Wizkid no accept de child and na dat one lead to issues between de two families for sometime till after 2 years wey dem go do paternity test before Wiz take responsibility.
2. Binta Diallo

Binta Diallo na Guinea-American singer wey born for Wizkid in 2016. The result of dia relationship na him second son Ayo Ibrahim Balogun from second babymama and like de first case, Wizkid gaz confam paternity before e begin do child support.
3. Jada Pollock

Jada Pollock na Wizkid manager before she become third babymama for 2017 when she born Zion Balogun. She don work with starts like Chris Breezy and Pia Mia.
Out of de three babymamas na Jada Wizkid quickly accept her dia child pass de first two even though till date he dey pay child support give all of dem.
Wizkid don win many awards for de industry throughout him music career and some of dem na. Some of de awards na: One Grammy award; 3 MTV EMAS; 3 Billboard Music awards; 12 Headies awards; 5 MOBO awards; 3 Soul Train awards; 4 NAACP Image award; 7 Afrimma awards; 5 African Entertainment awards USA; 1 Dance 8 Platinum; 2x Essence Platinum; and Come Closer Gold.
Watch how Wizkid and Davido take perform for Afrobeats Festival for Berlin