LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
DJ Cuppy early today begin trend on top de bird app after her papa, Nigerian businessman, philanthropist, and former chairman of Forte Oil PLC, Femi Otedola tweet about how e dey support Bola Tinubu to be president for de coming election
Twitter users begin blast Femi Otedola but trust Naija pipo when dem mean to drag you, dem go drag everything and everyone and for dis mata dem no free DJ Cuppy wey be Femi Otedola first daughter with him second wife Nana Otedola.
2023: I GO HAND OVER POWER GIVE YOUTHS – ATIKU
Wetin suppose be ordinary tweet don set DJ Cuppy up as fans come face am pass de person wey make de tweet gangan.
For de original tweet Femi say;
I am always excited visiting my Great Friend Asiwaju Ahmed Bola Tinubu
May God grant him his heart’s desire in becoming the President of this great Nation …F.Ote
Him support de post with picture of him and Bola Ahmed Tinubu wey dey run for 2023 presidential election along with Abubakar Atiku and Peter Obi.
I am always excited visiting my Great Friend Asiwaju Ahmed Bola Tinubu @officialABAT
May God grant him his heart's desire in becoming the President of this great Nation …F.Ote💲 pic.twitter.com/RaUkSPnxeb
— Femi Ote$ (@realFemiOtedola) July 5, 2022
See some of de tweets below;
Stopped taking the otedolas seriously during endSars when Dj cuppy wore iro and buba to protest with umbrella under the rain in her house.
— 𝕂𝕦𝕤𝕤𝕞𝕒𝕟 (@kusssman) July 5, 2022
We’re roasting Femi Otedola & DJ Cuppy but not a single person has said “Boss shey suffer no dey tire you?” this means one thing, they aren’t affected. The Rich will do anything in their power to remain rich, it’s now entirely your choice to remain poor. Fight for your future! 🥺
— Chlorpheniramine #EndSARS 🇳🇬 (@VictorIsrael_) July 5, 2022
Same Cuppy you’re dragging over her father’s choice of candidate joined the ENDSars protest, same Cuppy has been advocating for youths to go get their PVC and make the right choice. But go on.
— LERRY 👑 (@_AsiwajuLerry) July 5, 2022
What did DJ Cuppy do to you people?
Why y'all dragging her into this?😢
— Alabi (@the_Lawrenz) July 5, 2022
Who be DJ Cuppy?
Born as Florence Ifeoluwa Otedola for November 11, 1992, DJ Cuppy, or Cuppy as some pipo like to call am na Naija DJ and producer and de daughter of Nigerian businessman Femi Otedola. She grow up for Lagos before she move go London at 13years.
Cuppy play for MTV Africa Music Awards in Durban as de resident DJ, she later play for de Tatler and Christie’s Art Ball inside London, and for de Financial Times Luxury Summit in Mexico City.
She release House of Cuppy as her first compilation mix for London and Lagos in July 2014 before she launch am for New York on September 2, 2014.
That same year, Cuppy also launch a music management and content production business, Red Velvet Music Group wey dey for London.
Before all dis time, Cuppy been dey stay for Ilupeju and she stay there for six years before she move go Ikeja where she attend Grange School, Ikeja. She then relocate go London for her GCSEs and A-Level. She graduate from King’s College London in July 2014, with degree in business and economics.
She also collect master’s degree in music business from New York University in 2015. As at October 2021, Cuppy gain admission to secure master degree in African Studies for University of Oxford.
Cuppy say her sound na wetin we go call “Neo-Afrobeats”, wey be mixture of Electro house and Afrobeats and dis na as she take talk am for interview wey she do with Tush Magazine.
According to wetin she post for twitter on April 14, 2020, DJ Cuppy talk say she be vegan and dat one mean say she no dey chop animal as most pipo wey dey use am do meat.
As de mata don be, DJ Cuppy never respond to anything wey any one don talk so far as she no really be de type wey dey like controversy.
Watch her song with Fireboy DML: