LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
TIMAYA WEY DON TALK SAY E FIT NO MARRY AGAIN AS PER SAY HE DON DROP ALL IM GF CON GET NEW BABY.
Di popula singer wey know Timaya don give us plenty reason why e fit no marry.
Di singer talk am for im Twitter page on Wednesday wey be,June 8 2022.
E neva even reach few hours afta e announce say e don dump all im gf dem, and e don go buy Ferari 458 iconic car, and e con talk say e fit no marry again.
Di singer wey don already get four pikin from three different women talk say e fit no marry becos, becos Jesus Christ no Marry any woman and e (Timaya) na ‘Christ-like’.
”JESUS no marry. I be like Christ ”, he tweet.
“I leave all my gal friends and I don get new baby. FERARI 458 Iconic. CHULO way…”, he con even upload di photos join.
Di singer neva marry yet but e don dey wit plenty women dem. Wen e just start to dey sing, e bin dey date one movie star, her name na Empress Njamah.
Timaya and di actress break up after plenty Tina don apen as dem talk.
For one chat with media pesin Daddy Freeze for 2018, di music star talk how dia relationship crash and di drama wey surround di whole mata on top car wey e buy for am.
“I tell Empress say make she give me di car make I return am back to di lady, Empress tell me say she don use di car settle herself. I dey find am, dat na why I go dat church… I Dey talk am now becos of all di tins wey pipo dey talk “you buy gift, you go go am like Timaya” make una no vex, na my car be dat” he talk.
“I go di church because na my car, I bin get di spare key, I bin wan drive di car, so di security guys com dey look me, I con tell say, but na my car be dat, na my girl, na Empress carry dis car com church, di security con talk say make I go inside go call am come out and I tell dem say I no fit as per say service dey go on for inside church, so na from dia kassala burst.”
Timaya don already get four pikin, dia names na Emma, Gracey, Emmanuel and Maya and e get dose pikin dem from three relationships.
Im first baby mama, she be di mother of Emma and Gracey na im foma-girlfriend, Barbara Nwokolo, be graduate of di Benson Idahosa University wey e don date before e even become musician.
While im second baby mama na Tamar, an interior decorator(designer), di relationship last small and e spoil her with plenty gift wey cost afta she born one boy for am for 2018.
Di singer third baby mama, na America she dey live and na artist, her name na Dunnie.