LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
POPE FRANCIS DON GIVE HONOUR TO 15 NIGERIANS WITH PAPAL KNIGHTHOOD
Di Holy Father, Pope Francis, don honour 15 Nigerians from Delta State as e award dem di wondaful, important position of Papal Knights and Dames of St Gregory and St Sylvester.
WORSHIPPERS IN FEAR AS GUNMEN ATTACK CATHOLIC CHURCH FOR ONDO STATE
Di director of Communications, Catholic Diocese of Issele-Uku, Nigeria, wey be Rev Fr Charles Uganwa, talk am for one statement wey e make for Asaba, di Delta State capital.
He talk say, “Dem honour some of dem with Papal Medals. All dis men and women dem don prove demsef for di faith a good moral and dem don even contribute well well to make sure di church and even di society grow.
“Di pipo wey dem give di award na: Patrick Ikemefuna, Okechukwu Ofili, Epiphany Azinge, SAN, Benedict Chukwuma, John U T Okolo, and Joseph Emuezie. Odas na: Henrienta Odume, Rosaline Bozimo, Henrienta Ajuebon, Caroline Sotunde Patience Elumeze, Carol Enuha, Justina Nwaobi, NES, Elizabeth Okwuadi and Suzanna Nwabude.
“Di Bishop of Issele-Uku diocese, Most Rev Michael Elue go perform dia investiture ceremony on behalf of di Holy Father within Eucharistic celebration wey go take place for St Paul Cathedral, Issele-Uku on Saturday, for June 18
“Dem don hep to bring plenty positive development to Nigeria for all round. Di honour wey dey give dem na, diafor, clarion call on dem to take make sure say dem do more to take move di work of God and to dey brave as soja of christ for evrytin wey dem dey do.”
He talk say dis pipo wey dem give honour, and many odas dem, don be instrument to physical and spiritual devlopment of di local Church as dem dey hep to de do evangelism from scratch to finish for all di community.
E add say as soja of Christ and the Church wey dem be, Knights dey expected to get di fire and strong spirit of di Holy Spirit for di social apostolate, also say dem must make sure say dem get respect and dignity, professional ability, family and public sense, virtues wey dey related to good social behaviour, wey include honesty, sense of justice, sincerity, respect and make dem dey brave in good ways, na dat way dem fit dey religious or social apostolate.