LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Burna Boy come club Cubana with five police escort and as dem reach, four wait outside as one follow di singer enter di club.
DAVIDO, BURNA BOY TO RELEASE SONG OFF NEXT ALBUMS DI SAME DAY
As we hear di gist as Bar Beach Police Division take report, Burna dey VIP with di police escort wey him name na Inspector Ibrahim and 3 women when Burna Boy come sight another woman. He tell Ibrahim make e control di banny come VIP but as e turn out, di banny husband dey there and na like dat gbege start.
Based on anything wey dey him mind, Burna decide make e go meet di banny by himself and before we know wetin dey happen, mata don enter another level. Di police escort comot him service pistol come shoot for air na so everywhere scatter and as things calm small e come be say di bullet meet two pipo dia.
Even tho say some pipo dey talk say 27 year old Lawrence wey bullet hit for thigh na di banny boyfriend say no be husband but e get another of him friend Tolu, wey bullet also hit and na like dat di two pipo take carry injury.
As one source take talk, e say after di mata cast na so Burna Boy and him escort tuama. Read as e take narrate am:
“They eventually made their way out of the club and also shot into the air in order to escape. While all this happened, the Cubana management did nothing about it. In the first place, they ought not to have allowed anyone to bring in a gun into the club.
Another police source say Burna and him crew drive go one of him properties wey dey for Elegushi for Lekki-Epe Expressway before e come go Lekki Phase 1. As di source take explain am e say;
Aware of what he had done, Burna Boy took the next flight out without even informing his policemen. He only called them on video later to inform them that he had travelled to Spain. All his police escorts have been arrested and are currently at the command headquarters.”
When pipo come dey ask about di victims, close relatives say dem dey collect treatment for Lagos State University Teaching Hospital, Ikeja.
Di police source also confam say dem don arrest di five police officers wey dem attach to Burna Boy.
Katakata no be new thing for di Odogwu singer as police been don declare am wanted for 2017 after dem nab leader of di gang wey Burna Boy employ make dem go deal with fellow artist Mr 2Kay.
Dis Mr 2Kay matter start when both artist still dey Port Harcourt and we hear say na 2Kay been cause wahala and Burna Boy wey never too dey popular dat year tell 2Kay via tweet say make e keepsame energy when dem meet and as normal life be, di two artist come jam for hotel where dem lodge for an award.
After dem bust 2kay for di room wey e lodge, Burna Boy tuama and na so police declare am wanted before e come later enyer di country go clear himself and Mr 2Kay also say e don forgive am.
Based on wetin we know, Burna Boy never enter di country since and we go bring una more tori once anything sup.
Meanwhile watch di live performance video of Burna Boy ‘Last Last’ for Madison Square Garden.