LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
WOMAN DIE FOR HOTEL AFTER DEM GANG RAPE AM — POLICE
More dan 12 condoms wey dem don used, dem discover am for di hotel room, and the woman dead body, according to dem police.
Di police talk say dem find One woman wey don die, inside one hotel room for Abakaliki, Ebonyi State, after dem don already gang-rape am.
Di police don identify di victim as one 26-year-old Ugochukwu Nworie.
Di police spokesperson for Ebonyi, wey en Loveth Odah, wey spoke on behalf of di Commissioner of Police for di state, Aliyu Garba, disclose di matter on Wednesday for Abakaliki, according to di News Agency of Nigeria (NAN).
Mrs Odah talk say an officer (DPO) in-charge of a police division for di state bin report say di occurred for di hotel, Hope-in, for Ngbowo Street, Abakaliki.
Over 12 condoms wey dem do use, dem discover am for room, alongside di woman corpse, according to di police dem.
Di DPO bin dey on routine check for di hotel wen he con discover say dem never account for one room.”, the police spokesperson talk.
Di hotel receptionist, on enquiry, tell di officer say Im no know di guests wey occupy di
room.
Mrs Odah talk say di officer con get spare key from di hotel, open di door, and he con find di woman lifeless body, with her hands and legs wey dem tie to di bed.
Di dead body, dem don deposit am already for morgue.
di police spokesperson talk say di incident na something wey dey unfortunate and say na offence against humanity.
Mrs Odah, don vow say di police go arrest and prosecute di killer dem, she con advise di public, especially young women dem, say make dem dey very cautious and careful about Di people dem dey always go out with.