LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
2023: I GO SUPPORT ANYBODY WEY WIN APC TICKET — TUNDE BAKARE
Di Serving Overseer of di Citadel Global Community Church, Nigeria, pastor Tunde Bakare don purchase di All Progressives Congress APC 2023 Presidential Nomination and im Expression of Interest forms.
Speaking after he don pick di forms, di hot preacher wey note say God dey give power to whoever he want, say he go give support to any of his fellow aspirants dem wey clinch for di APC presidential ticket.
He say; “I trust say God dey help us with men of good will, East, West, North, and South from di country across party lines, male and female wey will rise up to take rebuild our nation for such a way, so dat di devastation wey we dey experience we no go see am again no more.
“Our programme dey very simple: peace, prosperity and progress and possibilities. Upon dose four pillars, Nigeria go dey rebuilt and the hope of many citizens go dey strong and rekindled.
“All of us go join hands to make am happen. No other nation fit fix our nation, e go take Nigerians wey dey all works of life, within and without and those wey don dey diaspora to join hands together to take build our nation.
“God dey rule for di affairs of men and he dey give am to whoever he will. One southerner na Nigerian, one northerner na Nigerian. We trust God say di best, di fittest, and di most competent go emerge and di one wey go truly love our people, especially di poor go rise to fix our nation. Many people dey run race but na only one person go wear di crown.
Na only one seat dey, whoever win am, di rest of us must rise to take support am to rebuild Nigeria. East, West, North or South, Nigeria na our country”, he declare.