LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
SPAIN DONATE 4.4 MILLION COVID-19 VACCINE TO NIGERIAN
Di government of spain don donate 4.4 million Johnson & Johnson vaccine to Nigeria.
N2.9B FRUAD CLAIM: EFCC DON FINALLY CARRY OKOROCHA GO CUSTODY
Di donation, dey say, e dey in line with the proper and of fair defense, say e dey equal, to di world so dem join di fite with di universe against COVID-19.
One statement for Wednesday from di Embassy of Spain wey dey Nigeria explain say di handover ceremony of di single-dose vaccine, e take place for di compound of di National Primary Health Care Development Agency in Abuja for Tuesday.
Di pipo wey attend di event na di Executive Director of di Agency, wey be Dr. Faisal Shuaib, di Ambassadors of Spain, Greece, Sweden, and Austria; UNICEF Director of Health, Mr. Eduardo Celades; WHO Deputy Country Representative, Mr. Alexander Chimbaru, and di European Union envoy, Ambassador Samuela Isopi.
Di statement talk say, “With di donation, Spain don stand out as di third donor of COVID vaccines wey don com Nigeria. Dis donation wey we do na biggest donation Spain don to one single country wey dey Africa so far.
As e talk join, dis number don put Spain as di seventh-largest donor of vaccines for di world, with 70 million dose wey dem don already deliver.
“Spain dey fully committed to multilateral efforts. As e Dey be sef, dis donation and more than 90 percent of Spanish donations dem, dey do am tru watin dem dey call COVAX mechanism.”
Addition to dat, di embassy note say di donation contain one more action of “Team Europe” for Nigeria, wey dey controlled by di European Union and di member states.
All togeda, di EU and EU countries don donate 30m vaccines to Nigeria so far.
To take win over di virus wey dey on ground, di Spanish ambassador, wey be Mr. Juan Sell, talk say e dey important say e reach every citizen and evry corner of di world, including di areas wey neva develop as dem fit no get di vaccine on time.
He talk say, “We gats give power to our primary health systems; and we must improve global mechanisms for technology to take transfer to take get control over di production of health products for all regions, especially for Africa.
“In dat sense, di President of di Government of Spain announce for di recent II Global Summit against COVID, say Spain go give $300m for di donation of dem go add anoda 30m COVID vaccines dem and say dem go make public health systems strong as dem go dey do projects wey dey related to COVID-19, and say di Spanish Agency for International Development Cooperation go start am”