LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
RCCG MEMBERS DEY PROTEST ABOUT DEBORAH SAMUEL DEATH AS DEM COVER DIA MOUTH WITH CELLOTAPE
one small drama apen for Abuja as di members of di Redeemed Christian Church of God, RCCG, dem start protest becos of di bad wicked death of Deborah Samuel, one 200-level student of Shehu Shagari College of Education, Sokoto, as dem talk dey talk say she talk watin she no suppose talk untop dia prophet and dem kill am.
AMVCA FALLOUT: DRAMA AFTER SOCIAL MEDIA TREND DEY GO ROUND.
Di protest wey dem do against di religious killing for the country, dem do am after Sunday service for di Central Parish, Wuse, Abuja na di regional pastor of di parish wey no gree to talk him name to Journalists, na im lead di pipo.
Di protest, be peaceful one becos of no wahala apen, and di pipo wey also be RCCG church memba dem, close dem mouth with cello-tape to take pass di message well well to di pipo.
Di protest pipo carry signboard wey dem write ‘Stop di killing’, ‘God dey watch’, ‘No dey kill in di name of religion’, ‘No go dey defend di indefensible‘ and ‘make we live togeda for peace’.
Recall talk say di President of di Christian Association of Nigeria, CAN, wey be Dr. Samson Ayokunle don tell Di Kristain wey dey di kontri, say make dem do di protest small small so dem no go dey get threat from Muslim pipo wey wan do dia own protest or harm anybody.
E tell di church lidas dem say make dem fo Di protest inside di compound of di local churches or for di CAN Secretariat.