LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
NAF JET DON BOMB BOKOHARAM/ISWAP CONVOY FOR BORNO, KILL MANY TERRORIST.
Di Air Task Force (ATF) of Operation Hadin Kai for weekend obsav Boko Haram/Islamic State of West African (ISWAP) terrorists convoy and kill many of di terrorist dem for air raid for North East of Borno,”Zagazola report.
NO PLAN DEY TO REPLACE NAIRA NOTE — CBN
One top Intelligence sources tell Zagazola Makama, wey be Counter Terrorism Expert and Security Analyst for LakeChad
One Source talk say dem excute Di successful air interdiction mission on May 21, for Wara Wara – village for Damboa Local government area.
Di source say add join say dem go still continue to dey employ sir that air-power to take cripple di bad pipo dem. Dem don succeed to clear anoda group of bad pipo for we country.
E continue, di source talk say dem launch di air raid under di subsidiary Operation Desert Sanity, after dem don do difrent looking as dem use am as mission, dem con see say di lookout show say terrorist activity dey go on around Korede, Shettima Affor, Kalolowa village and Wara Wara villages under Damboa.
Top Intelligence and Counter Terrorism Expert dem Security Analyst for Lake Chad, wey be Zagazola Makama don confirm di operation as he talk say di Super Tukano score better and bad hit from Di kidnappers too, dem destroy four of dia guntrucks as dem dey fight and even som of dia fighter, dem kill dem and some wound for di process.
E talk say for about 0800 hours, one team of di terrorists go dey go toward Wara Wara – to go remove of di dead Mujahedeens and dem con dey go toward Litawa village, for Damboa axis, one position wia dem go lata go do burial prayers for di people wey don die.