LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
FORMER MINISTER, EWUGA PILOT-DAUGHTER AND 11 ODAS DIE FOR PLANE CRASH
Di former Minister of State, FCT, wey be Senator Solomon Ewuga’s daughter, Adzuayi Ewuga, na female pilot, die for plane crash in Central Cameroon.
WHY I STAB MY EX-LOVER
Report talk say di pilot, wey die for one mini-aircraft wey belong to Caverton Aviation Cameroon, bin get 11-passengers wey dey on board.
According to local media reports dem, di aircraft bin dey fly from Yaounde Nsimalen Airport to Belabo, for di east of di country when air traffic services con lose radio contact.
Di deceased na di second daughter of Senator Solomon Ewuga, one stalwart of the People’s Democratic Party (PDP) for Nasarawa State.
Caverton Aviation Cameroon na subsidiary of Caverton Offshore Support Group wey base in Lagos, Nigeria, wey dey also control Caverton Helicopters dem.
Di Nigerian sister-carrier also bin dey operate one single DHC-6-400 wey dey complement various helicopters to take provid support for di country’s oil and gas industry.