• About
  • Contact
  • Privacy Policy
No Result
View All Result
  • Login
Amebo Update
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
No Result
View All Result
Ameboupdate
No Result
View All Result
Home News

BLAST FOR KANO: HOW GAS EXPLOSION KILL NINE PIPO FOR KANO

by Ruth Nwachukwu
May 18, 2022
Reading Time: 3 mins read
0
BLAST FOR KANO: HOW GAS EXPLOSION KILL NINE PIPO FOR KANO
326
SHARES
2.5k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING

CLICK HERE


BLAST FOR KANO: HOW GAS EXPLOSION KILL NINE PIPO FOR KANO

AMEBOUPATE don confirm say na gas explosion happen for kano, and so far na four people die but we don confirm say e don don reach nine

Na Nigeria ministry of humanitarian affairs confam dis one say dem recover victims from di rubble of di building wey di blast occur.

Di explosion also affect di outside of one school wey close to di place.

Before now, Kano State Police bin talk say na four pipo die for di explosion wey happun for Sabon Gari area of Kano, Northern Nigeria.

HOW THE MATTER TAKE HAPPEN

Investigation dey go on but initial reports wey AMEBOUPATE don discover be say na gas cylinder from one welder shop na im cause dis explosion.

Di Kano state commissioner police CP sam’ila Dikko tok say, “no be bomb explosion, na gas cylinder explosion. We know dis because one of di first victims na welder for di area”.

E add say, “four pipo lose dia lives wey include three men and one woman but we neva find student wey be victim of di explosion.”

Sabon Gari Market President President Nafi’u Nuhu Indabo tell AMEBOUPATE di tori say e affect plenti pipo wey include school pikin dem for di area.

Di state Commissioner for Information ask pipo wey dey live for di area to dey calm and collabo with goment authorities for investigation.

For statement, Malam Muhammad Garba say, “di incident bin happun for animal feed shop opposite one school for Aba road Sabon Gari area of Fagge local government”.

Malam Garba also add join say di goment go continue dey inform di public on any informate for dis mata and tell pipo make dme no dey spread tori wey dem neva confam.

Meanwhile Kano state deputy govnor, Nasiru Gawuna don visit di scene of di explosion.

Kano na di most populous city for northern Nigeria.

For plenti years, Kano don dey largely spared from di extremist group Boko Haram.

But about ten years ago one massive bomb attack by Boko Haram kill more dan 100 pipo in one mosque for di city.

Nigeria don face plenti explosions for long no be today.

For April, one illegal oil bunkering site for Im state explode and many pipo bin die.

Also na explosion, armed men take stop di Abuja Kaduna train for march wia t least eight pipo die for di attack.

For January 2022, gas tanker explode for Ughelli for Delta state wey kill at least two pipo.

More pic of scene:

 

Previous Post

MASSIVE EXPLOSION FOR KANO, FEAR DEY SAY MANY DON DIE

Next Post

2023 PRESIDENCY: NO PDP CANDIDATE FIT CONTEST WITH ME — TINUBU

Ruth Nwachukwu

Ruth Nwachukwu

Next Post
2023 PRESIDENCY: NO PDP CANDIDATE FIT CONTEST WITH ME — TINUBU

2023 PRESIDENCY: NO PDP CANDIDATE FIT CONTEST WITH ME — TINUBU

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No Result
View All Result

Categories

  • BBNaija (33)
  • Celebrity (251)
  • Culture (9)
  • Fashion (2)
  • Food (1)
  • Health (20)
  • Lifestyle (67)
  • Music (27)
  • News (633)
  • Travel (25)
  • Uncategorized (21)

Recent.

Gunmen attack Taraba Catholic church

Gunmen attack Taraba Catholic church

August 15, 2022
Former Ondo governor Mimiko don meet Peter Obi

Former Ondo governor Mimiko don meet Peter Obi

August 11, 2022
Herdsmen kill six pipo for Benue

Herdsmen kill six pipo for Benue

August 11, 2022

For all the better totori wey dey we entertainment, music and other gbedu wey dey burst brain.

  • About
  • Contact
  • Privacy Policy

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

No Result
View All Result
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In