LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
AMVCA FALLOUT: DRAMA AFTER SOCIAL MEDIA TREND DEY GO ROUND.
Di Fans of di Nollywood actors and content creators dem don continue to dey hype dia favorit winnings for di last Africa Magic Viewers Choice Awards (AMVCA).
GUNMEN DON KILL ANODA AREA BOY FOR OGUN STATER.
Di News Agency of Nigeria (NAN) as dem dey keep tab of social media trends, however, obsav say di AMVCA follow with plenty drama ontop som celebrities dem and di outfit wey dem wear go for di award.
On May 15, former Big Brother Naija housemate, wey be Ifu Enada’s, Di cloth wey he wear to di AMVCA con be topic as some fans dem like di dressing, while som of dem dey talk say di cloth no fine, and na di popula designer, wey be Toyin Lawani (Tiannah Empire) sow di cloth.
For her reply to di pipo wey dey talk say her cloth no fine, Ifu Enada, for one long post for her Instagram page, talk said, “All my look e worth over 100k USD. Yes you, read am right.
So if you no get at least up to10k USD for your savings account, you no get right to speak on how I look. So watin I Dey talk be say, no dey bad mouth my cloth if you no get money “.
Within seconds, “$100,000” con start to dey trend for Twitter, as her fans dem con dey ask if di cloth wey she wear reach dat amount atall.
Watin happen after di AMVCA drama continue for Monday ,wen one stylist call out actress Dorcas Shola-Faison, say she dey owe her money for cloth wey she wear go di AMVCA.
Di actress, however, no gree to respond to di matter wey di stylist talk, but she con later post one pic of hasef, wia she dey use middle finger do “fuck you” sign and she con put caption “your opinion”.
On di same day, popular British-Nigerian singer, wey be Azeez Fashola, as we all know am as Naira Marley announce say im new album wey go title “God’s Timing’s The Best” say e go release am on May 30.
Nollywod also con mourn di death of actor Leo Mezie, wey die after one long battle with kidney disease.
For Tuesday, Nigerian flutist(person wey dey play flute) with cross-cultural Itsekiri and Swiss roots, TeeMac, celebrate im birthday as fans and collig dey pour praise ontop am.
American rapper, wey be Jonathan Kirk, as e popular as Dababy, im sef trend after he share one video of an as he dey buy popcorn for $100 for inside Lagos traffic.
NAN report say Dababy com Nigeria to com shoot one music video with popula Nigerian singer, wey be Davido.
Nigerian comedian and content creator, wey be Josh Alfred, pipo know am as Josh2funny, dem celebrate on Tuesday after he welcome im pikin wey be baby boy with im wife, Bina Alfred.
On Wednesday, popular Nigerian singer, wey be Olamide Adedeji, lead trend for social media after he post one video of imsef as e dey dance to one song wey Zazu crooner sing, Habeeb Okikiola, wey dey popula as Portable.
For Thursday, American rapper DaBaby Lagos trip also cus small clash betwin Nigerian rapper, wey be MI Abaga and journalist Joey Akan. Di two of dem dey give demsef word for social media as di journalist dey accuse MI and oda rappers dem say dem dey feel demsef.
On Friday, Nollywood actor, wey be Blossom Chukwujekwu, tie di knot with his bride as dem don marry, her name na Ehinome Akhuemokhan for Edo.
Chukwujekwu, wey just separate from im ex-wife don dey show case picture of im new wife on im Instagram page.
Also, Ayinla, one movie for di story of late Nigerian Apala musician, wey be Ayinla Omowura, wey veteran filmmaker, Tunde Kelani, e trend as soon as dem start to dey show am on Netflix.
For Saturday, di award winning Nollywood actress, wey be Funke Akindele trend for early hour of di day, wen her step son, wey be Benito, go say som tins against am.
Benito for im Instagram page go dey talk say di actress no dey treat her workers well at all, say she dey even abuse dem. He con even talk say Funke and her husband don even cheat on eachother.
One Twitter user, wey be OMOTAYO of Lagos@Tee_Classiquem1, however, write say, “But why be everybody dey accuse Funke Akindele say she dey treat her workers bad? I mean say, I don’t see as she use her platform to take bring pipo like Toyo baby, Kiki, James, Adaku, Timini and odas and dem blow, shey dis tins na set up or somtin dey wey we no know ?”
Funke Akindele, however, no even do like say we concern her as she post one video for her Instagram page wia she dey show off her awards with her crew members dem. (NAN)