LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
6 SOLDIERS DIE, COMMANDING OFFICER DEY MISS AS TERRORIST AMBUSH DI TROOP FOR TARABA.
No less dan six soldiers of di 93 battalion, Takun, for Tuesday dem kill when suspected terrorists/bandits dem go ambush one convoy wey dey carry di Commanding Officer of di Battalion while on im way to Jalingo.
Di ambush attack, dem talk say e occured for about 6.30am around Tati village on Tuesday morning
Sources talk say following di ambush, di whereabouts of di Commanding Officer, wey be Lt. Col Okore no con dey certain as e lead to suspicion say dem fit don kidnap am.
According to di source, di six soldiers wey dem kill during di ambush include one Staff Sergeant, two Sergeant’s, and three Lance Corporals.
Meanwhile, following one counter blockade operations by troops for Ananum village, around Donga, troops neutraliz two bandits/terrorists as others escape insidebush with gunshot injuries.
Di troops wey dey part of reinforcements from Mararaba for Nasarawa state, dem talk say dem bin embark on anti-ambush drills to take over power di bandits.
Among items wey dem recover from di bandits be AK 47 rifle,AK47 Magazines, local made gun and many rounds of 7.62mm Special ammunition.
As for di time wey dem file di report, di Authorities of di Nigerian Army for Taraba State and Army headquarters dey yet to comment on di development