LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
2023 PRESIDENCY: NO PDP CANDIDATE FIT CONTEST WITH ME — TINUBU
All Progressives Congress, APC, presidential aspirant, wey be Senator Bola Tinubu don urge delegates of im party to give am di presidential ticket for di coming 2023 general election as e dey assure dem dey nobody go dey wey go contest between am and whoever become di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP.
TERRORIST DON KIDNAP OVER 20 PEOPLE ALONG ABUJA-KANO ROAD.
Senator Tinubu wey speak on Tuesday while he dey address delegates and stakeholders dem of di APC for Makurdi talk say e get di capacity and also say e dey endowed to lead di country people dem.
E talk say he bin dey di race to do watin resemble watin he do for Lagos state as Governor as he take build a united and prosperous Nigeria.
As he dey raise di hope of Nigerians for di unity of di country, Senator Tinubu assure say his presidency go redirect di resources of di country and e go make am beneficial to every citizen.
He say: “I go bring di experience of my leadership for Lagos state as a Governor to take bear on my leadership style for Nigeria when una elect me as president of di country.
“And I guarantee you say I will run a transparent, and open government as President. Nigeria dey rich, watin we need na to redirect our resources and to channel dem for di right direction.
“I Dey urge una, make una give me di ticket becos no contest between me and whoever go will emerge as candidate of di opposition for PDP.”
Senator Tinubu even urge Nigerian youths say make dem entrust am with di leadership of di country as he assure say he go meet all dia expectations.
Earlier, Senator Kashim Shetimma don recall and extol all di leadership qualities of Senator JS Tarka wey come from Benue state describing him am di leader and emancipator of di minority interest groups for Nigeria.
He talk say Senator Tinube possess di leadership qualities as he describe am as di right person to take Nigeria to di promise land.