LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
MAN GIVE ZAMDFARA 14-DAY ULTIMATUM TO PAY N30m OVER IM DEATH OR HE GO KILL 300 PEOPLE.
Nasanda, one terrorist king pin for Zamfara State don give 14 day ultimatum to di State Government to pay am N30 million as compensation for di alleged killing of his wife and im two relations dem.
NDLEA BURST COCAIN CARTEL, ARREST EVEN TRAFFICKERS.
He threaten to kill 300 people if dem no meet im demand. Nasanda don claim say his bride, his uncle and his aunt, dem kill dem by some vigilante men for di state.
For one recorded audio message wey dey trend on social media, Nasanda saiy di murder of his bride, her uncle and aunt dey intentional.
He alleged say di vigilante men know say di dead were related to him. For Di audio message, he say he dey realistic and no dey greedy to ask for di N30 million compensation.
“If Say I Dey greedy, I for ask for N50 million per person,” he say.
According to him, ” I no dey give am months, but 14 days, say make dem meet the demand.
And I no go attack until when people dey go dia farms. If our Fulani people no dey allowed to live in peace, we no go also allow others to live in peace,” he say.
“If di government no pay di money, I go do watin if dey used to. Dat is I go take the life of 300 people to take avenge di death of my bride and two of her relations. Yes, di lifr of 900 go dey for danger,” he say for the audio recording.