• About
  • Contact
  • Privacy Policy
No Result
View All Result
  • Login
Amebo Update
  • Home
    • Home – Layout 1
    • Home – Layout 2
    • Home – Layout 3
    • Home – Layout 4
    • Home – Layout 5
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
  • Home
    • Home – Layout 1
    • Home – Layout 2
    • Home – Layout 3
    • Home – Layout 4
    • Home – Layout 5
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
No Result
View All Result
Amebo Update
No Result
View All Result
Home News

LATEST ON NNMADI KANU COURT TRIAL

COURT TRIAL OF THE FAMOUS IPOB LEADER, NNAMDI KANU.

by Ruth Nwachukwu
April 12, 2022
Reading Time: 4 mins read
0
LATEST ON NNMADI KANU COURT TRIAL
326
SHARES
2.5k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING

CLICK HERE



A federal high court wey dey Abuja don strike out eight out of the 15-count charge wey dem carry put untop kanu head say him do, dem con file am for court against Nnamdi Kanu, for those wey no know, kanu na the leader of the indigenous people of Biafra(IPOB), by the federal government. 

Ninth Nyako, wey be the judge, wey dey rule on top Nnamdi Kanu application on Friday. Him strike out counts 6,7,9,10,11,12,13 and 14.

Nnamdi go also stand for trial in counts 1,2,3,4,5,8 and 15.

“For this instant preliminary objection application, I don read all the counts and counts 6,7,8,9,10,11,12 and 14 no show any offence”. Na watin the judge talk.

Count 1, 2, 3, 4, 5, 8 and 15 shows some proof of watin them talk say he do.

Kanu dey face seven count charge wey border on terrorism, treason, secession and dat im be member of IPOB group wey goment don outlaw.

“The court go start to dey try the defendant (Nnamdi Kanu) on those counts.”

E no dey clear wen Kanu land for court but people confam say security operatives sneak di leader of di IBOP group enter di court on Thursday morning.

Nnamdi Kanu don spend approximately 18 weeks for detention since im re-arrest for June, 2021.

Nigeria goment never tok wia dem arrest di Ipob leader. Wetin Nigerians see na wia Minister of Justice, Abubakar Malami tell tori pipo say dem don arrest di Ipob leader.

CHARGES ON TOP NNAMDI KANU HEAD AND CHARGES WEY THEM REMOVE.

On June 29, goment carry am go federal court for Abuja but media no get chance to cover di proceeding.

Also on June 29, Justice Binta Nyako order detention of Kanu for Department of State Services (DSS) facility.

Di judge wey dey try di matter promise to speed up di trial before she adjourn di case.

Dis trial dey come days after Nigeria President, Buhari talk say in no dey consider any political solution on top Nnamdi Kanu case and e talk say Kanu must face di law.

Kanu wear di same Fendi cloth wey im wear for foto wey first go round for the first period dem arrest am for June.

Kanu plead not guilty to di new charges wey Nigeria government talk say e do.

Kanu trial for court dey always come wit drama as security pipo no go allow pipo freely enta di court premises.

Nnamdi Kanu go stand trial for court on charged amended 15-count charge bordering on treasonable felony.

Mike Ozekhome, Kanu’s lead counsel, talk say the charges na “defective and baseless”. Meaning say the charges get comma and no proof.

He talk say the application dey seek the “quashing, striking(canceling) out and dismissing(removal) of di 15-count amended charge” for being “incompetent and denying the court of jurisdiction to entertain the suit”.

The application, of assuming on 34 grounds con dey supported by 36-paragraph affidavit, also dey seek for order make dem do cancel con release Nnamdi Kanu.

“You dey accuse Nnamdi Kanu say e Dey make some broadcast. You no even talk where them do the broadcast una Dey talk say he do. Shey e do am for the spirit world, or do am  for air or under the ground?” Ozekhome ask them.

He even talk say with all the provisions for the federal high court act, person wey wan prosecutor(blame) person suppose give the normal things wey Dey necessary, like the exact information of the place where the matter take happen and how e commit am, na that time them fit blame am for the things wey them talk say e do.

Ozekhome wey be Nnamdi Kanu lawyer carry the application he con asked say make the court to comot all the whole charges wey dey untop kanu head.

As the matter be, Shuaibu Labaran, wey be the prosecution counsel, asked talk say make the court dismiss(remove) the defendant’s application.

Kanu lawyers wey dey defend am bin don file for application say make di Ipob leader dey transferred to correctional centre as di trial dey go on. But court no agree, them no grant di application, dem talk say make e remain for DSS hand, as e be dem Dey give Nnamdi Kanu tight security.

One of Kanu lawyers Alloy Ejimakor post photos on Facebook to confam di Ipob leader presence

Many IPOB Supporters wey dey Kanu back, dem gada for di Federal High Court wey dey Abuja to show am love and support. After the trial, all of them gather for front of the court don dey sing solidarity songs.

Many Nigerian TV stations carry the news. TVC News, Channels and other media outlets them. Below na the link of the stations wey carry the news of IPOB lawyer for interview with press wey dey defend am.

Previous Post

WHO BE MRS OSINACHI NWACHUKWU WATIN BE THE CAUSE OF HER DEATH

Next Post

CHARGES ON TOP NNAMDI KANU HEAD AND CHARGES WEY THEM REMOVE.

Ruth Nwachukwu

Ruth Nwachukwu

Next Post
CHARGES ON TOP NNAMDI KANU HEAD AND CHARGES WEY THEM REMOVE.

CHARGES ON TOP NNAMDI KANU HEAD AND CHARGES WEY THEM REMOVE.

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No Result
View All Result

Categories

  • BBNaija (31)
  • Celebrity (226)
  • Culture (9)
  • Fashion (2)
  • Food (1)
  • Health (19)
  • Lifestyle (67)
  • Music (26)
  • News (580)
  • Travel (24)
  • Uncategorized (18)

Recent.

WHY I STAB MY EX-LOVER

WHY I STAB MY EX-LOVER

May 17, 2022
FORMER MINISTER, EWUGA PILOT-DAUGHTER AND 11 ODAS DIE FOR PLANE CRASH

FORMER MINISTER, EWUGA PILOT-DAUGHTER AND 11 ODAS DIE FOR PLANE CRASH

May 17, 2022
FG DON SUSPEND BASKETBALL FOR NIGERIA FOR 2 YEARS.

FG DON SUSPEND BASKETBALL FOR NIGERIA FOR 2 YEARS.

May 17, 2022

For all the better totori wey dey we entertainment, music and other gbedu wey dey burst brain.

  • About
  • Contact
  • Privacy Policy

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

No Result
View All Result
  • Home
    • Home – Layout 1
    • Home – Layout 2
    • Home – Layout 3
    • Home – Layout 4
    • Home – Layout 5
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In