LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
GOODLUCK EBELE JONATHAN DEY GIVE CONDITION TO TALE JOIN APC AS NWC CONSIDER WAIVER FOR NEWCOMERS FOR THE ELECTION.
Di Former President of Di federal Republic of Nigeria wey be Goodluck Jonathan go also dey join di All Progressives Congress presidential race on di condition say he dey endorsed by di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.), Saturday as Ameboupdate don learn.
DIRECTOR OF ‘KING OF BOYS; KEMI ADETIBA DON TIE KNOT WITH GHANIAN LOVER.
Anything wey dey short of di no go dey acceptable to Jonathan wey bin serve as deputy governor, governor, Vice-President and even President on the platform of the Peoples Democratic Party from 1999 and 2015.
Ameboupdate don gather information for February say some northern emirs bin don reach out to the former President Goodluck, dem ask am say make he contest.
Jonathan also don stay away from activities of the PDP, including the last national convention.
Former Governor wey Sule Lamido of Jigawa State don also state say e dey very unlikely say Jonathan na still member of di PDP as he bin no longer dey involve for all di party activities dem.
On Thursday, however, posters of di ex-President flood over di national secretariat of APC for Blantyre Street, Wuse 2.
On Friday, youth and women group dem con dey demonstrate outside of Jonathan’s office wey dey located for Maitama area of Abuja.
Di demonstrators dem, wey arrive inside five large buses, hold up placards some of which wey read, ‘Jonathan, Please Run’, ‘Jonathan, abeg do di needful’, ‘Jonathan for 2023’, ‘Jonathan Declare Now’ and ‘Goodluck Abeg Come Back, We Love You’.
One spokesman for di group, Mayor Samuel, wey be also the Convener of the Youth Compatriots of Nigeria, said, “We were deceived and brainwashed by those who claimed they could do it in 2015.
“Now, we don know better, under Jonathan di minimum wage fit buy us one or two bags of rice. Watin we don get today? We dey beg President Jonathan make he forgive us, we don realize our mistakes; we want am back to complete watin he bin start.”
Jonathan subsequently don invite di leaders of di protesters for one private meeting. After di brief meeting, di ex-President con address di demonstrators wey dey outside, advise say make di youths to run for office instead, adding say di constitution don been dey amended as far back as 2018 in order to take give di youths a chance to contest.
Di ex-President con talk say he no dey sure say he fit run for the office of president. He, however, ask say make them ‘watch out’.
“Yes una don dey call on me to come and declare for di next election, I no fit tell if I go still declare.
Di political process dey ongoing but just watch out.
Di key role wey una must play go be say Nigeria must get somebody wey go carry young people along,” the former President add.
However, onw top source for di APC tell Ameboupdate say di former President dey seek assurance say he go dey handed di party’s Presidential ticket.
Di APC chieftain, wey wished to remain anonymous/make dem no call him name, say,
“Jonathan don already been President before. So, di APC no fit offer am anything except di Presidential ticket. Imagine say e contest against Osinbajo and Tinubu and he con still loose? Shey no be better disgrace be that?
“So, he don make his position clear. If he go even come to the APC, dem must give to am the assurance say dem go give am di party’s ticket. Dis na his demand.”
Di source add say di former President, Dem fit sell am as “compromise candidate” amid all di raging zoning debate for the country.
“Jonathan na di only Nigerian wey dey alive wey fit promise to serve only one Presidential term and abide by it because he dey limited by the constitution.
If he serve one term, then power go return to the North. No be even easy decision but I fit assure una say di President Buhari no go get any qualms with a Jonathan Presidency,” he add.
Meanwhile, e dey learnt say di APC National Working Committee go give special waivers to select aspirants base on di powers wey deu conferred on it by the National Executive Committee.
Section 31.3 of di new APC constitution titled ‘waiver’, read in part, “Subject to di approval of di National Executive Committee, di National Working Committee may, for special circumstances, grant a waiver to person wey dey seeking a national party office, wey no otherwise qualified under di constitution if, in its opinion, such waiver na for the best interest of di party.
“Subject to di approval of di National Executive Committee, di National Working Committee may, in special circumstances, grant a waiver to a person seeking the office of President, Vice President, governor, deputy governor, senator, member of di House Representatives, wey dey otherwise no dey qualified under this constitution if, for its opinion, such a waiver dey in Di best interest of di party.”
Di Nigerian constitution and di Electoral Act state say anyone wey dey contest for presidential election must be member of a political party wey go sponsor am as a candidate.
However, both the constitution and di Electoral Act no go prohibit non-party members from participating for primary.
However, one member of di party’s NEC tell Ameboupdate say waivers go be on a case-by-case basis.
Jonathan’s Spokesman, Ikechukwu Eze, no even respond to all di calls.