LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
DI EX- BEAUTY QUEEN WEY BE MUNACHI ABII DON DEY TALK BACK TO PEOPLE WEY DEY SHAME AM SAY SHE NO SABI SPEAK IGBO WELL.
Di Nollywood actress and former beauty queen, wey be Munachi Abii, don respond to people wey dey criticize am after dem don slam am on social media say she dey unable to speak Igbo language well well.
MEET MY SON FROM MY SECOND WIFE – YUL EDOCHIE
Dem bring Munachi as guest for BBC News Igbo on Friday, April 22, wia she bin talk about her personal life, family, and career dem.
As she dey Speak during di session, di lady wey dem born for Imo State-born and na actress bin dey speak Igbo and she dey use English language dey follow am.
However, Muna demeanor no con dey good enough for some people as dem con start to dey make fun of her, say she no sabi speak better Igbo.
Reacting to people wey dey criticize her, Muna talk say she no go ever understand why people dey talk all kind of tins because of say she no get di ability to take command her nature language make flow well well for her mouth.
“I no fit ever understand why people go dey shame people wey dey even show say dem dey really try dia possible best to speak dia language.
she write for her Instastory to take react to the comments dem.
“At least I fit speak something. Di people wey dey go dey shame person, no even fit even speak any language proper and dem resemble sorrow wey get oil untop”. She add.
Munachi be di former winner of di Most Beautiful Girl in Nigeria for 2007. She be Igbo lady who come from Mbaise, Imo state.