• About
  • Contact
  • Privacy Policy
No Result
View All Result
  • Login
Amebo Update
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
No Result
View All Result
Ameboupdate
No Result
View All Result
Home Lifestyle Health

CANCER

THE THING WEY DEY GROW FOR PERSON BODY WEY BE LIKE KOKO

by Ruth Nwachukwu
April 10, 2022
Reading Time: 3 mins read
0
CANCER
327
SHARES
2.5k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING

CLICK HERE

WATIN BE CANCER- Cancer na disease wey be say, something wey oyinbo dey “cell” go dey grow inside person body pass how the suppose dey, e go con dey go spread go for body.

The thing fit start anywhere for body, because human body get up plenty plenty (trillions) cells.

If the cell dey grow e go con form koko, dem dey call am “Tumor”

SOME FACTS WEY PERSON SUPPOSE KNOW ABOUT BREAST CANCER

  1. For Nigeria, 1 in 8 women dey diagnosed with breast cancer for their lifetime.
  2. Di most significant risk factors for breast cancer be say, as woman and as person Dey old. About 95% of all di breast cancers for Nigerian occur in women wey dey 40 and above.
  3. Women wey dey get regularly screened for breast cancer have a 47% lower risk of dying from the disease compared to those  people wey no dey go for screening.
  4. Breast cancer deaths don dey  reduce as time dey go since 1990 thanks to early detection, better screening, increased awareness, and the new treatment options wey dem Dey use treat cancer.
  5. For Each year e dey estimated say over 220,000 women them for the Federal Republic of Nigeria dem dey diagnose dem with breast cancer and more than 40,000 go die.
  6. Breast cancer na the second leading cause of cancer death among women in the Nigeria and the first leading cause of cancer death among women globally.
  7. In Nigeria today, there are more than 3.5 million breast cancer survivors — di largest group of all cancer survivors.
  8. Every 2 minutes, a woman dey diagnosed with breast cancer for the US.
  9. Every minute, somewhere in the world, a woman dey die from breast cancer. That’s more than 1,400 women every day.
  10. A man’s lifetime risk of breast cancer is about 1 in 1,000.

THINGS WEY DEY CAUSE CANCER

  1. Age- cancer fit take long time to grow, that na why many old people from 65 years and above dey get am more. But e no mean say younger people no fit get am. Like this sef even small children dey get cancer.
  2. LIFESTYLE- The way person dey live life fit affect am, person wey dey drink too much, smoking sef dey cause am, person wey dey always get Injury from sun infact people wey dey bleach fit get am, person wey too fat sef dey and if dey fuck anyhow without condom.
  3. FROM FAMILY HISTORY- some people dey get cancer from their family members, e fit be from mama or papa or even their family. e go dey their body, oyinbo dey call am “GENE”.
  4. AREAS WHERE PERSON DEY- Person wey no dey smoke fit get cancer, why ? Because the person go dey breathe the smoke wey another person dey smoke, or company waste, or chemicals sef.

HOW PERSON FIT AVOID CANCER

  1. NO SMOKE- If you dey smoke Stop am, if

you no dey smoke no start am, smoking fit give person lung and throat cancer. Even fit give person other types of cancer as time dey go.

2. No dey too much inside sun, if you dey use bleaching cream make you dey very careful because some of the chemical dey make sun dey too touch person and e cause watin oyinbo dey call “Radiation”

  1. Dey eat better food, wey go make your body stand gidigba con fit fight diseases and infections. Dey chop, fruits, vegetables, protein etc
  2. No too fat because if person too fat e no good atall.
  3. If you like to dey drink, no drink too much so your body fit dey balance.
  4. If you see say you dey feel somehow, go do test and if you notice any koko for body and you sure say no he boil, see dokita.
Previous Post

FAMOUS MUSICIAN, MR EAZI DON FINALLY PROPOSE TO TEMI

Next Post

BANKY W DEY RUN FOR SIT COMING 2023

Ruth Nwachukwu

Ruth Nwachukwu

Next Post
BANKY W DEY RUN FOR SIT COMING 2023

BANKY W DEY RUN FOR SIT COMING 2023

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No Result
View All Result

Categories

  • BBNaija (33)
  • Celebrity (251)
  • Culture (9)
  • Fashion (2)
  • Food (1)
  • Health (20)
  • Lifestyle (67)
  • Music (27)
  • News (633)
  • Travel (25)
  • Uncategorized (21)

Recent.

Gunmen attack Taraba Catholic church

Gunmen attack Taraba Catholic church

August 15, 2022
Former Ondo governor Mimiko don meet Peter Obi

Former Ondo governor Mimiko don meet Peter Obi

August 11, 2022
Herdsmen kill six pipo for Benue

Herdsmen kill six pipo for Benue

August 11, 2022

For all the better totori wey dey we entertainment, music and other gbedu wey dey burst brain.

  • About
  • Contact
  • Privacy Policy

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

No Result
View All Result
  • Home
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In