LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
BREAKING: ALAAFIN OF OYO, LAMIDI ADEYEMI DON DIE AT 83
Di Alaafin of Oyo, wey be Oba Lamidi Adeyemi III, don kick di bucket.
He be 83 years old.
BREAKING: NIGERIA POLICE DON DECLARE 12 PEOPLE AS WANTED IN ANAMBRA FOR KILLING AND TERRORISM.
Di top Yoruba monarch die for di late hours of Friday, according to di palace officials dem.
Adeyemi die for di Afe Babalola University Teaching Hospital, Ado Ekiti.
Di late Alaafin’s first son, wey be Prince ‘Tunde, and other children don receive the monarch’s remaining body for Idi-Igba, Oyo town for early Saturday morning.
Palace sources don confirm say di traditional rites dem don already start but Dem
no give us details about his burial arrangement dem yet.
Adeyemi rule for 52 years before he die, and dat one make am di longest-reigning Alaafin.
By tradition, di head of di Oyomesi, Basorun of Oyo, High Chief Yusuf Ayoola, go take over di appointment to take get new Alaafin.
Basorun also dey expected to brief di Governor of Oyo State, wey be Seyi Makinde, before official announcement.
Di late Alaafin of Oyo na from di Adeyemi branch of di Alowolodu family. Dem born am on October 15, 1938.
As he dey for im late childhood stage, he don live briefly at Iseyin.
Adeyemi III na di son of Oba Adeyemi II, di former Alaafin of Oyo wey dey deposed and dem bin send am into exile in 1954 say be have sympathy for di National Council of Nigerian Citizens.
He con succeed Alaafin Gbadegesin Ladigbolu II for 1970 and dey crown am on January 14, 1971.
He like boxing well well.
Adeyemi’s death come after di death of di Soun of Ogbomoso, Jimoh Oyewumi, and di Olubadan of Ibadanland, Saliu Adetunji, wey die on December 12, 2021, and January 2, 2022, respectively.