LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Nollywood actress Nkechi Blessing and her husband, Opeyemi Falegan marriage don crash as dem don confirm say dem no dey together again.
Even tho say people been dey think say them marry, but for di first time on Wednesday, Nkechi use her mouth talk say she no ever marry Falegan.
WHO BE MRS OSINACHI NWACHUKWU WATIN BE THE CAUSE OF HER DEATH
Di two lovers don make am clear say them no get anything together again as husband and wife and dis tori na on top dia different page on top Instagram dem cast di mata.
HOW E TAKE START
Everything start when person for one blog talk say Nkechi dey sleep with one realtor make she for get endorsement deal. Comot acting wey make am dey popular, Nkechi Blessing dey into real estate too and she be di managing director of one real estate company.
After the mata cast, na e we know say the whole gbege start when one blog leak say Nkechi dey run mata with one real estate person make she for use am get endorsement deal.
Apart from say she dey act, na she be the Group Managing Director for one real estate wey di name na Ojulowo – Omoluabi Empire Holdings Limited for Abeokuta, Ogun State capital. As the mata leak na e we hear say Nkechi and the owner of the company dey do many-many things based on likeness.
Of recent di actress don dey lose some of her fans and pipo dey blast am because of plenty rumor wey just dey fly everywhere.
Di blogger even tag Nkechi say she be Falegan wife.
As she respond to the thing wey dem talk, Nkechi, cry well well, con dey swear for di person wey talk say she dey secret relationship, na later we come know say na Gistlover carry di update come.
Di Surulere-born actress wey come from Abia State say di relationship don end since February when she send am comot from her hotel room.
For di same video wey she don delete now, she tell her over 2million followers on top Instagram say she be lesbian and she get dem plenty woman wey she dey run mata with and she even dey look for more. She talk say she fit beat hand for chest talk am anywhere say she be lesbian and nothing go fit happen.
Based on wetin she talk, she say she dey come out with her full chest say she be lesbian, con dey ask wetin happen if she be lesbian?
Her husband Felegan deny say he be her husband. For the video on Wednesday, he talk say e no be nobody husband.
He con talk say e no wan make anybody know am for any thing bad or make e get issue with anybody sake of say e get name to protect and dat name na him pride.
As e talk am for English, e say;
“I have a name that I am trying to protect here. Anything at all, husband of who? Where did you see the husband?“I’m not the husband of a lesbian, put some respect on my name.”
When she address di mata on top her Instagram, Nkechi Blessing talk about talk some kind things as per di gbege. She even talk say if any body dey with am, make them ready to feed am.
BEFORE
For February, Nkechi husband go Instagram, celebrate her with long epistle for her birthday.
Falegan wrote: “Happy birthday, my goddess, my hope, joy, and happiness. Please be with me forever, my love. My eternal love for you is my vision, my hope, my goal, and my soul. Together forever.”
In the comment session, Nkechi wrote, “My property is my property. It’s forever, daddy. So use love to choke me tonight.”
Social media pipo wey oyibo dey call “netizen” shock when after all the “awwwwn” and “God when?” di couple come out say e don be on top Instagram on Wednesday evening.
When they ask am, she dey cry for one of the live videos, di actress talk say she be partner for Ojulowo- Omoluabi Empire Holdings Limited and na real estate company, say for every land wey she sell she dey get commission.
Read more of wetin she talk as she take talk am;
“So tonight, Gistlover published that I am dating the Chairman of the company, Omoluabi Estate, and that got me freaked out. But before I can say, Jack! I saw a video where Opeyemi was saying, ‘I am nobody’s husband and all,’ and that got me extremely angry, and that was what caused my anger and outburst.
“Meanwhile, I was never married to him, but because I call him ‘Oko mi’ Yorubas, take it that he is my husband, but he is never my husband.
“For Omoluabi, he is just a man always interested in business and business alone. When people like him continue to make money, people will think it is a money ritual.
Una don get di gist and as e be so na make them continue to do well for anything wey dem involve because life no dey wait or stop for anything.
Watch di live video;