LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
All di Relatives of passengers abducted from one Kaduna-Abuja-bound train don give d federal government of Nigeria 72 hours ultimatum make dem ensure say all dose people wey dey for d hand of di abductors dem(people wey kidnap) make all of dem get dia freedom back.
Briefing newsmen for Kaduna, di pesin wey talk on behalf of di families, Dr Abdufatai Jimoh, talk say if dem fail to ensure d release of the passengers wey dem kidnap, they go do whatever dey very necessary to secure say di release of the people wey dem love, he dey insist say d government get watin e take to make sure dem release all of dia relatives.
He con explain say, “We dey appeal to di government make dem do everything wey dey necessary to get our loved ones out of captivity(bondage). We already don decide, all of us together, say we dey give d government 72 hours make dem do everything wey dey necessary to bring out our loved ones back.
“ For dis event if d government fail to do so, we don dey ready to do watin dey necessary to secure di release of our loved ones but we know say di government dey better position to do am.”
The man talk say the kidnappers no even gree make dem talk with relatives dem, also talk say dem no even get di number wey dem go fit reach the people wey kidnap them.
He con dey explain say, a day after dem kidnapp di passengers from di Kaduna-Abuja train, they kidnappers contact the relatives them but since den, the line of communication don go cold. Mean say dem never contact see
Since den.
”Many of us bin communicate with our affected relatives and the promise wey d bandits give us be say, make we dey ready say dem go contact us. Today na di fifteenth day, we ever hear any communication from dem.
“E dey very painful say, since dis incident happened, we dey expected say by now di government, Nigerian Railway Corporation and even d Ministry of transportation, dem don suppose don know the relatives and make dem tell us, di effort wey dem dey do to make sure say dem rescue our loved one for safety becus we beliv say na di responsibility of di how make dem protect d lives and property of d citizens of Nigeria in general.”
He con add join say, “We believe say our government dey capable to doi am, and we dey trust say di government fit do am. Until a few days ago, we don been dey expect to receive phone calls from the kidnappers because na watin dem bin promise us when we see di video, dey make am clear to s say watin dey want na to discuss with di govment say dem get something between dem and govment.”