LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
While some persons dey talk say my sister die of throat cancer, others dey say she died as a result of domestic abuse by Peter Nwachukwu, her husband. Mean say the husband been dey beat her up, dey maltreat her.
For interview with Vanguard, the deceased’s sibling (sister) opened up on watin be d cause of d gifted singer’s death.
“She no die from cancer. Her husband wey be Mr Peter Nwachukwu hit am with im leg for herchest. All dis while, he don dey beat her but my sister been dey hide all the thing she dey pass through from us,” Favour her sister talk am.
“Even Before now, we don tell her make she comot for that marriage, we don told say no be say them dey divorce but na just ordinary separation. But she been dey feel say God Dey against divorce.
“We tell am, say separation no be sin but just say for her make she dey alive and make she fit take care of her children. She dey always tell us say make we relax and dat d man go change. So when d man kick my sister for her chest, she fall down for ground, he con carry her go hospital and he no even tell us say something happen.”
Her sister talk say them be no know about the latest incident until one of the friend of Osinachi wey don die now. Con call Osinachi sister inform am of watin sup.
“Na her friend wey dey live for Ebonyi state call her twin sister because Osinachi been get twin sister, she con ask am say. ‘your Sister tell you say dat Peter hit her for her chest? d sister say no, I never hear,” she talk.
“Na the hit wey Peter give my sister for chest na watin kill her be that. My brother even con dey ask the doctor watin killed her and d doctor talk say “there were clusters of blood clot on her chest”. Mean say plenty blood gather for her chest.
“Unfortunately, dey been no tell the doctor say person kick am for her chest because the doctor fit for know watin to do for her if bin say he get idea of watin happen to her before dem come the hospital. Each time wen we dey talk to her, she go dey beg dey plead for peace and if we con move to act, she go tell us say NO, say make all of us calm down.”
According to Favour, Osinachi and Peter meet for one of her ministrations.
Osinachi’s colleagues dem dey talk say di Dunamis International Headquarters’ lead singer dey always get abused by her husband Peter Nwachukwu. Her Fellow singer wey be Frank Edwards talk for one Instagram Live session say the 42-year old’s husband don physically assaulted her numerous times. Edwards con add:
“One time for di studio, dis man slap am just becus say she been wan record the wey she wan song in Igbo and because say e dey against his will. She no dey do anything on her own. She go con talk say, abeg beg my husband. She been dey at his mercy. I know even know way watin she dey pass through reach all these ones; I no even know how somebody go just dey jealous of di wife wey he claimed e love.”
Chidinma Ezego, who claimed say she be her friend, mentioned say “she don dey been die in silence.” Di singer was kicked in her chest and had been on life support for five days before she con finally die. Ezego add join:
“Remember how he dey tie her up and asked make d children beat her up with cane. She tell me this one.
Dem don arrest Peter Nwachukwu for FCT Lugbe police on April 10. Dis one
come after Osinachi’s brother suspect say na homicide cause his sister’s death.
Amebo Update go bring una more news on the matter.