LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
2023: FEW NIGERIANS POSSES WATIN E TAKE TO BE LEADER, OONI TELL
ILE-IFE—Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, yesterday, bin dey commend di leadership quality of presidential aspirant, Mr. Rotimi Amaechi, and e con pray for God protection and blessing upon am, as he dey seek the highest office for Nigeria.
ASUU STRIKE: REMA DON REACT TO BOWEN UNIVERSITY OPEN INVITE.
Di Ooni talk am when Amaechi pay am consultantation visit for im palace, ile-Ife.
Oba Ogunwusi say: “With di roll out for your resume, how many of una like am for Nigeria? Very few. For di last 23 years of di Republic, you don dey showcase. Power belong to God. No be by your might, no be by your power, or by how you dey do.
“In term of leadership, na only God dey give power, and if you look for your history, for di last 23 years, you don actually go through the rank and file. You no be the only person for this country, but God don actually find favour for you, and by di very special grace of God, get di interest of dis country for heart. E dey very important. I know say you dey very strong and hard believer of God Almighty, anything wey you do, you pray to God.
“No go relent, do not relent, no stop to dey pray well to God.““Leadership na stewardship.
You don dey different leadership positions from different strata. In terms of governance, you don see everything. But di one wey you dey try to reach now, by di special grace of God, God go take you there. We dey pray for you from di throne of Oduduwa.
“Abeg remember di country for good, remember di goodness fit still come out of this country, remember say you go continue to dey serve for good, not be for your own interests.”
For his talk, di Minister of Transportation propose review of legislation make dem give more attention to the traditional institution if dem give am the opportunity to serve as Nigeria’s President.“Amaechi say: “One of Di serious issues wey I want make this country look at is di importance of traditional institution.
If dem elect me, as president of di country, I go sit down with di National Assembly to take address the relevance of di traditional institution, because a lot of things dey get out of hand.
“You no fit be president for Abuja and know watin dey happen for in Ife, you no fit be governor for Osogbo con know watin dey happen for Ife. There must be somebody for Ife to talk to. There must be somebody wey go understand di entire Ife Kingdom wey you fit take view from, to see how much contribution he fit make for the administration of di state and that of di country, for us to move forward.”
So for me, e dey necessary to consult di traditional institutions for di governance of dis country. Most of di heads of di traditional institutions dey educated and very exposed, them dey see tins for themselves, dem dey see watin dey and e dey important make Dem involve dem for the ruling for di country”“Amaechi also talk say his former performance for governance, his physical and mental fitness qualify am to dey able to manage di country.
He con promised to put eye for every sector wey dey necessary to improve di economic reality of Nigerians.