LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
2023: APC DON MOVE TO ADOPT INDIRECT PRIMARY.
Indication show for Tuesday night for Abuja say di wey be Senator Abdullahi Adamu-lead National Working Committee NWC of di ruling All Progressives Congress APC dey propose di indirect primary method for Wednesday’s meeting of the National Executive Committee NEC.
CHRISLAND: ‘ YOU GO MISLEAD DI PUBLIC’ – NIGERIANS DEY TELL UBI FRANKLIN PVER DI RAPE STORY.
Ameboupdate gather say most members of NEC don already buy inside di idea and dem
Fit just vote for method wey go dey adopted.
Di NWC don meet for several hours on Tuesday to take talk on several issues wey also include di timetable for di general election primaries.
We even get report say for di meeting dey even considered di costs of nomination and expression of interest forms for all di elective offices wey go come up for di coming election.
“Di NEC na di highest decision making organ of Di party, all our decisions for the NWC meetings of last week and di one wey hold today (Tuesday) go dey presented to di NEC for approval tomorrow (Wednesday). Dis one go form di main agenda for di meeting.
“We don make our recommendations and e dey for di NEC to approve di various costs pegged(put) to various positions.
Mind you, di NWC don approve free nomination forms for all female aspirants, irrespective of the position wey dey wan contest for”, we get for one party source.
On di mode of primaries, he talk say Article 20(3 and 4) of di APC constitution 2022 (as amended) “dey clear on di mode of primary to take use for di congresses and convention, but for di primaries for di 2023 elections, we don recommended indirect mode of election. Dis also we go present am to di NEC for ratification.”
Di youth wing of di party go also present dia earlier adopted position calling for di party to grant a 50 percent waiver to youth contestants.