LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
2023: ABIOLA SON, KOLA DON DECLARE FOR PRESIDENCY.
AHEAD of di 2023 Presidential election, di eldest(first) son of late Chief Moshood Kashimawo Abiola, wey be winner of di June 12 presidential election, Im son Kola Abiola don declared say e go contest for di most exalted position for country under the platform of Di People’s Redemption Party, PRP.
WE FIT DUMP APC – AREGBESOLA LOYALIST.
According to am yesterday for Di PRP National Secretariat, Kola Abiola talk say “Today make my formal inroad after 27 years back for inside politics, just as he talk say the only party wey fit give di youth such opportunity to make dia number count na the PRP.
“I particularly pick to come back into politics through di PRP for some good reasons.
“I don go back to di history of Nigeria to go look at di party wey don truly represent Nigeria. I do go back and I don find out say the oldest living party wey dey na the PRP, and e still hold those ideals of watin Nigeria and democratic practice suppose be like.
Di party na party wey dem start by di people and truly for the people. Na party wey don show first, as its priority, internal democracy.
“I don come back to PRP to show Nigerians day not too long ago, we don do thing in the right way and the new entity wey don come together nowadays forget say one Nigeria bin dey wey dey do things right.
“I be one wey believe for equal opportunity employer be it employment, be it business, equally in politics and I believe this party represent all of dis tin.
“Everybody suppose get equal opportunity irrespective of age, religion and ethnicity amd wey dey represented here.”
Abiola wey raise concerns over di low participation of youths for politics, say“We get a youth population wey don dey caught out of the system, the political process.
“Di first thing I wan do na to disrupt di political process, to disabuse di minds of di youth on godfatherism.
“Di way to do this na to give di true owners of Nigeria, wey is, the 18 to 36 years age group wey make up over 75 per cent of di population an opportunity for their voice make e dey heard and make their numbers sef count.”
On his part, Di Chairman of di party Mr Falalu Bello talk say “I formally welcome you into our fold. Your antecedents dey speak volumes”.