LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di driver of di Lagos state BRT bus wia dem kidnap and kill Bamise don give tori of wetin happun dat night.
Im tok afta police confam im arrest by di Department of State Services, DSS on Monday, 7 March 2022.
Dis na afta police bin confam di death of 22-year-old Oluwabamise wey bin miss since 26, February 2022 afta she enta di Lagos state goment BRT bus from Ajah area to Oshodi area of Lagos.
Di driver for im own side of di tori don deny say im get hand for Bamise death.
Na di driver tori of wetin happun be dis
For inside video wia one tori pesin dey ask am question for wia dem detain am, di driver of di BRT bus wey still dey in im dark and sky blue driver uniform wey dey crested wit Lagos state logo tok wetin happun dat night.
“Why I run sir? Wen those guys show me di weapon as I was saying sir, I no fit be myself anymore. Fear catch me, so whatever di man wit gun tell me to do na im I dey do. Wen I follow dat Carter Bridge, afta dat overhead bridge, dem order me to stop dia, and wen dem order me to stop, dem say make I open di door, wen dem come down, dem come start to dey drag her down.
Wen I see say she dey cry for help I dey helpless. So, I bin dey tink say she dey inside di vehicle, holding di iron, so I move on, I leave her for dat scene, I neva know say dem drag her down. I no get any connection wit anyone of dem, e bin just passenger, I no get connection wit dem.” Na so di driver tok.
Na talk be this one?