LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di police officer wey bin investigate di controversial death of Sylvester Oromoni Jnr for December 2021 don tell di coroner wey dey hear di mata say investigation of the five senior students of dowen college wey dem suspects of bullying and assaulting di deceased no conclude before dem release dem from one remand home based on court order.
Dis na despite one protest letter wey di police command for Lagos sama di chief judge of di state wey ask say make dem revoke di bail wey dem grant di boys before di 30-day remand order expire.
Di IPO Bamidele Olusegun for the homicide dept for state CID Panti confam am during im cross examination wey Femi Falana (SAN) lead.
Di letter of protest wey dey among exhibits before di coroner, wit date December 22, 2021 against di bail wey dem grant di underaged boys, wey be suspects for Sylvester death dey signed by DCP Fayoade Adegoke wey be oga for homicide investigations for Panti.
Inside di police investigative report wit date Dec 23, 2021 another exhibit, di witness add say di claims say di deceased dey bullied, tortured by di suspects and forced to drink one kind substance no dey confam.
But dem add say one of di suspects for 2019 been get suspension from school for yeye behaviour wey include spitting on one teacher.
Di witness still acknowledge say di school no scold another suspect wey beat up di deceased for October 2021 because e bin ask am to describe di private part of im elder sister wey follow dey Dowen college.
Oga olusegun also tell di coroner Mikhail Kadiri say di police report conclude say “e dey evident say some group of students for the school dey into one clique to dey bully and intimidate fellow students for di school.
Say di three school housemasters – Valentine Igbokwueze, Ahmed Ayomo and Adesanya Alusesan dey negligent, passive and fail to take action when dem report cases of yeye behavior to dem.”
But di police add say dem no fit go on to prosecute dem sake of lack of evidence.
Di court don adjourn to Tuesday Feb 22 for counsel for Dowen college, Anthony Kpokpo and oda counsel to cross examine di witness.