LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Popular Naija Instagram skit maker, Ashmusy, don drag one Lagos filling station like tiger gen, after dem sell water as fuel.

Ashmusy been tok dis one on top her Instagram page say, her generator and car don get plenty wahala ever since she buy deir fuel wey be water.
According to her, her motor been get wahala just as she dey comot from do station and she say wetin shock her be say, oda pipo wey comot from di station, follow get wahala with deir motor.
Ashmusy don tok say, she go fit carry di filling station go court and she don even drop video of di water wey dem sell as fuel for bowl.
FULL VIDEO
“Igbo men are the sexiest of all Nigerian men” – Bolu Okupe
Also, popular Instagram blogger, Tosin Silverdam, dey for cloud nine after he buy new motor.
Tosin Silverdam wey don dey shake everywia for social media with gist don dey enjoy di fruits of him labour as he don buy better salon wey reach millions of naira.
Tosin been carry him testimony come share with fans for Instagram say, gossiping don dey put food for him table follow put money, for him pocket.
Dis na how he tok am:
“Better late than never, so I finally got my first car at 31. I know it’s a small car but then again this is just the beginning. Even though I can’t drive and still learning how to drive😂. Gossip is really paying the bills 💵… God is good 😌”.