LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Anambra State Commissioner for Social Welfare, children AND Women Affairs, Lady Ndidi Mezue, don visit 94-year-old widow, Mrs Veronica Mgbokwe Nwafor, after some of her step sons for Imeohia, Ururo, Umunze for Orumba South LGA, break down di house wey person been dey build give am.
Di tok be say, one of di old woman step son (3rd wife son) been dey build bungalow give am, after dem don build am go reach wia dem wan roof am, some oda stepsons come destroy di building.
Di visit by Lady Ndidi to Nwafor family on Friday, na due to order from di state government to make sure say dem don take care of di matter well well.

Di matter been first cast on top Social Media say, e get one old woman wey dem dey build house give and say some kain pipo don come break di house after e remain small to complete. We follow see some videos sef of di old woman wey been dey cry and some pipo dey try console am.

According to di history of di family, deir papa, Late Nwafor Okoro, been don marry second wife wey go look after im pikin dem after im first wife die. After some years, he been follow marry di third wife.
Di person wey been dey build di house na di son of di late third wife, Mr Linus Nwafor. Linus mama and di 94-year-old been dey live for di same mud house after deir husband die. He been wan build di house give im step mama say, na she been dey take care of dem after deir own mama die.
Di 94-year-old mama, Mrs Veronica Nwafor, get only one daughter wey don marry, as her own son been don die. She don dey live with her daughter for over thirteen years now.
Di sons of di first wife been target di house after dem see say e go soon ready say, she no get any right for di family as she no get son. Deir names na Emmanuel Nwafor, Izuchukwu Nwafor, and Chidiebere Nwafor. Even though dem don jakpa, one of dem dey cool body for Zone 13 of the Nigerian Police Headquarters, Ukpo, Dunukofia Local Government Area.
According to wetin di Commissioner, Lady Mezue tok, di State Governor, Willie Obiano, don tok say make di project start sharp sharp say, di goverment dey chuk eye well well for di matter.
NGO don finish up di house of di Oldest husband and wife for Enugu state





