LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
One 70-year-old man wey dem dey call Leo, don prepare everywia for im own burial. Leo wey get 9 wives, don dig im own grave, buy him own coffin togeda with di white clothe wey he go wear for inside di coffin. Leo don follow buy mineral for di pipo wey go come him burial.

As Afrimax ask Leo why he do dis kind ting, Leo tok say, pipo from him village dey very poor and e dey hard well well for dem to fit find money, bury deir person wey don die. He follow tok say, he no wan be burden for anybody after he don die.
Leo don follow buy cement and blocks wey dem go carry do him grave and he don settle di undertakers in advance.

Leo don follow tok say he want make only men dem bury am. He tok say he know say he go soon die and na so so preparation he dey for now.
As Leo don arrange everytin for him burial, he dey use di remaining part of him life to chop life well well.
Watch di full video for here:
Stepsons don breakdown house wey dem dey build for 94-year-old widow inside Anambra State