LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
One child from Dowen college wey tok say she be friend of di late 12-year-old Sylvester wey die don tok say dem beat am well well and she and im friend been even carry am go sick bay one time.
Di child follow tok say one of di children wey beat Sylvester been jump fence comot from school and even di parents no bring am come back. She follow tok say di family of anoda of di student wey beat up Sylvester been use convoy come carry am from di school.
On top dis one, di family of di late Sylvester Oromoni don tok say make Naija pipo no protest before hoodlums go scatter di protest. Di family tok say dem go follow di case to di end.

Sylvester Oromoni Jr been dey Junior secondary for Dowen College, Lekki, Lagos, before he die very sadly.
Watch di video of im friend wey dey tok as e shele: