LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
52-year-old Australian socialite, Stephanie Rodriguez, don tok how dem cut off her two legs and how she suffer for 18 months after she contract cerebral malaria from mosquito for Lagos, Naija, when she visit.

According to wetin she tell Sydney Morning Herald, di single mama and business owner tok say she visit Naija for 2019 to come tok to di guests and after di meeting, dem been comot outside to go snap picture and na for deir mosquito bite her three times for her left leg.
Rodriguez follow tok say she been carry insect repellant wey she been dey use well well but she been no take any malaria medicine as di thing been no go well for her body di last time wey she take am.
Dis na how she tok am:
”The organisers asked me to go outside for a photo shoot with delegates. They had drones, shot B roll [extra footage], and vox pops. It was filmed next to a pool of stagnant water. It was sunset. That’s when I believe I was bitten three times by a mosquito on my left ankle”
She tok say di only time wey she come begin dey feel one kind na when she go India and she come dey tire anyhow but she no take am as anything wey serious. She follow tok say na when she fly go Boston she go sick well well for airport so from deir he go hospital wey dem tok say she get cerbral malaria.

By di time wey doctors for Massachusetts General Hospital go confirm say na malaria, she been don already dey unconscious and doctors tok say na only 2% rate of survival she get after di drug wey dem dey take treat strong malaria no go well for her body.
On di last attempt to save her life, doctors been use drugs wey dem call vasopressor to carry blood from her legs go vital organs and from deir her leg bcome begin dey die.
After she come fly back to Australia, doctors go cut off her teo legs wey been don die together with some fingers. She don dey use wetin dem call ‘above-ankle bilateral ossepintegrated implats and mechanical feet’ to waka well again.
Doctors don advise Queen Elizabeth II make she rest for at least 2 weeks after recent health scare
