LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di Zamfara State Police Command don rescue 24 kidnapped victims for di state.
According to wetin di state commissioner of police, Mr Ayuba Elkabah tok to journalists, di Police Tactical Operatives wey dem send go different parts of di state don successfully rescue 24 kidnapped victims for Shinkafi and Tsafe LGAs.
Among di people wey dem rescue na four students of Government Day Secondary School Birnin Yero, Shinkafi LGA, wia dem abduct during WAEC exams and one student of Federal Polytechnic, Kaura Namoda LGA.
Dis na how di Commissioner tok am:
UNICEF don confirm 25 attacks, abduct of 1,440 Naija pupils for 2021
“On Nov. 22, at about 1900hrs, Police Tactical Operatives deployed on Shinkafi axis, while on search and rescue operations, with regard to abduction of the students and other victims, acted on intelligence and rescued the students, along with eight others.
The victims, who spent 60 days in captivity, have now been rescued unconditionally.”
Elkanah also tok say security agencies no dey sleep over di banditry wahala wey dey occur for di state, say dem go do everything wey dem fit to arrest di matter. Di victims go undergo medical checks and police debriefings before dem go hand dem give state government to find deir family.