LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
US vice president Kamala Harris go dey serve as acting president while President Joe Biden dey under anaesthesia for routine colonoscopy, according to di White House.
Dis na wetin White House Press Secretary, Jen Psaki tok:
“As was the case when President George W Bush had the same procedure in 2002 and 2007, and following the process set out in the Constitution, President Biden will transfer power to the Vice President for the brief period of time when he is under anaesthesia. The Vice President will work from her office in the West Wing during this time.”
Mr Biden been arrive at Walter Reed Medical Centre on Friday for di annual examination, di first one since he become president.
Mr Biden wey go turn 79 on Saturday, na di oldest person for US history wey don hold office of president.
Before Mr. Biden, Mr Trump been pass as di oldest president in history with 70 years for swearing-in, 2017. Fellow republican president Ronald Reagan been pass as di oldest before Mr Trump with 69 years when he enter office for 1981 and 77 years when he leave office for 1989. Mr Biden been enter office at di age of 78.
Ms. Harris na di first woman wey don serve as vice president and di first wey don wield presidential power.
Dis medical examination dey come after citizens been dey concerned about President Biden age. Di administration don tok say dem go carry out di examination and di results go dey public.