LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Delta State Police Command don arrest one serial ATM thief and fraudster for Ozoro, Isoko North LGA of di state.
Spokesperson of di command, DSP Bright Edafe, for him statement on Tuesday, November 9, tok say di suspect, Ojo Amos, wey be 38-year-old indigene of Agbara-Otor, Ughelli North LGA, dey thief ATM from innocent people wey no too sabi.
Dis na di statement:
“On 2/11/2021 at about 1300hrs, upon a tip-off that the suspect was seen in a POS Stand located beside a bank in Ozoro branch, the DPO Ozoro Division detailed operatives who swung into action in conjunction with the chairman Olotu vigilante in Ozoro. They were deployed to the scene and arrested the suspect. 33 ATM cards and a cash sum of Fifty thousand Naira (#50,000) were recovered from him,”
Di suspect been confess say on eof di cards wey he thief na from one Rufai Abdulahi for bank inside Kwale. He also tok say he later comot N250,000 from di account.
3-year-old pupil don get bad bruises after teacher flog am [photo]
Di suspect follow tok say he dey eye old people, children or who never go school if dem get any wahala for di ATM. He go memorize deir pin, thief di card go withdraw for POS or ATM.
Di commissioner of police, Delta State, CP Ari Muhammed Ali, tok say make everybody stay away from wahala and make dem dey shine eyes as dem dey use ATM make nobody wey no be bank staff near dem.