LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Lagos State Government don begin to dey do DNA test so as to identify di bodies wey dem recover from di remains of di collapsed 21-storey Ikoyi building wey happen for Monday, November 1st.
According to di statement wey state Commissioner of Information and Strategy, Gbenga Omotoso, release, twenty-nine families don submit samples for DNA make dem fit identify di body of deir loved one wey die for di collapse.
Di government don set up committee wey go supervise di identification and release of di bodies and na senior officials of di Ministry of Health and Ministry of Justice dem put inside.
Lady in shock after caterer wan jakpa with fried meat and fish wey dem suppose give guests (photos)
Omotoso follow tok say for any case wey e clear well well and arguments no dey, dem go release di body give di families from dis week.
He follow tok say rescue operation go continue for di site until dem make sure say nobody dey for di rubble.