LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di Lagos judicial panel on police brutality been submit deir report give di state government yesterday, November 15.
Di panel been submit two sets of reports, one na report on police brutality cases and two na di Lekki tollgate incident investigation to di state governor, Babajide Sanwo-Olu for State government house, Ikeja.
Governor Sanwo-Olu been receive di report and he tok say di be thing na “difficult process of proper reconciliation and restitution”. He follow tok say dem go submit di report to National Economic Council (NEC) and “proper response ” go follow.
Di panel been deliberate on 186 of di 252 petitions wey dem submit and dem been give N409.7 million to 70 petitioners.