LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
A zoo handler dey very lucky to dey alive after one visitor been jump inside alligator tank to save her after di alligator been bite her hand.
Dis one been shele for di Scales & Tails reptile center for Salt Lake City, Utah, on Saturday, August 14th.
One Utah reptile centre employee been dey do presentation give one group wey been dey deir to do birthday party. She been don open di alligator enclosure make she fit give am food, but di alligator been wan turn her to food so he bite her for hand, drag her inside him house.
One of di visitors wey be Donnie Wiseman, 48 years been jump enter di water climb on top di reptile make di thing fit comot mouth for di handler hand.
Shane Richins, wey be di company owner talk say, di handler been wan give di alligator food as e dey do but di reptile been dey “a little extra spunky”.
Wiseman been dey on top di alligator until di woman dey free. He talk say di alligator don reach 7 feet and if to say e big pass Dat one e for hard well well.
Richins talk say di handler don get surgery and antibiotics.
Watch di video for here:
24 family members don die of suspected food poisoning for Sokoto