LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
We no go argue say no be small thing to put pikin for school not to talk of plenty pikin dem.
Divinar Joseph na mama of 5 children and she born 4 of them for one belle.
She don talk say money wey she take buy only school uniform minus transport and school fees for her 5 girls don reach KSh 44,550 (N168, 432.40) and na only one one be that oh so she go need buy another set give dem.
See how this: Girl don confess say her mother give her rat poison to put for her father food.
Divinar talk say she been wan dey teach her children for house but she gats comply with di government directive wey be say every student go collect NEMMIS number. After she go check 2 schools for her area wey people say dey good, she come finally choose one.
The school wey she choose go charge her KSh 50,000 (189,249.88) for her elder daughter while di 4 twins dem go be KSh 34,000 (N128,689.92) per head.
This na wetin she talk:
“I was given a good deal though. The school gave me a full scholarship for two of my children up to high school,”