LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Human rights activist, Kola Edokpayi, don talk say dem go resist any attempt to force Edo people make dem collect di Covid-19 vaccination.
Dis na how he talk am:
“My body is my right. Governor Godwin Obaseki respect my right. We shall vehemently resist any attempt to force Edo people to take Covid 19 vaccines.”
Di activist been talk dis one on top Facebook post on Saturday, August 28th, after di Governor been talk say anybody wey no get proof of Covid-19 vaccination no go enter public facilities or large gatherings.
Governor Obaseki been talk dis one during di flag-off of di second phase of Covid-19 vaccination for Benin. He talk say di number of people wey get di Covid-19 infection dey grow and government dey try see if dem go fit reduce di number.
Obaseki talk say dem dey look how dem Wan vaccinate 60 percent of di people within one year.
FG don receive 699,760 doses of AstraZeneca Covid-19 Vaccine