LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
New video don comot for on top social media wey di Taliban militants been dey drink, dey chop for inside presidential palace wey di President of di countri, Ashraf Ghani and him cabinet been dey live.
Some of di militants been dey Sidon on top sofa while others been dey chop, dey gist, laugh for di palace.
Di Taliban don take total control of di war torn country and every western countri dey try to fly deir citizens and diplomats out of di countri as fast as possible.
On Sunday, August 15th, di former president, Ashraf Ghani been run comot for di countri go di neighboring countri, Uzbekistan as di Taliban been dey enter di capital, Kabul.
By Sunday evening, di Taliban been don already declare di countri as’Islamic Emirates of Afghanistan’ make e come be like 2001 when di group been rule di countri strong strong so tey women no fit do anything, open mouth or go school.
Watch di video of di Taliban militants as dem dey chop life for inside presidential palace here:
See photo of inside U. S. Military aircraft wey dey evacuate Afghans from Kabul to Qatar