LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Legendary highlife musician, Prof Victor Uwaifo don die. Na today, Saturday, August 28th, di musician die at di age of 80.
Di music icon wey be say him best songs till he die ja “Joromi” and “Mammy Water” na ogbonge instrumentalist and singer.
One of him pikin, Uwaifo Peter de Rock, been carry dis gist come say, di Professor of Visual Arts for University of Benin don kpai on top him social media page dis evening.
Even though di child no talk wetin kill am, we don see say di thing shock am well well.
Dis na how di son talk am:
Actor, Prince Ifeanyi Dike don die
“Daddy. Why Did you leave us now. Prof sir Victor UWAIFO has gone to rest. Black Saturday for me now. One week now after colflaborating with me.”
Di legendary musicologist been serve as Commissioner for Arts and Culture under di governorship of Lucky Igbenedion.