LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Taliban don kill one woman for Afghanistan after she comot without burqa for public according to reports.
Fox news been don publish di photos on Wednesday, August 18th and we don see woman body for inside her own pool of blood with people around her.
Buhari been no fit chop after dem kill Muslim travellers for Jos- Isa Pantami
Dem been execute di woman after she comot for Taloqan, Takhar province, without burqa.
We don follow see as di Taliban dey parade di streets with guns and we dey hear say dem dey hunt down di people wey been support di American soldiers especially after di 9/11.
Dis one still dey happen even after di new Taliban leadership been promise say dem no go revenge anything and dem go give amnesty.
Di Taliban spokesman, Zabihullah Mujahid, been talk dis one and he follow say dem go protect di rights of Afghan women “within the rules of Sharia law”.
2-year-old South African girls don die after dem lock dem inside house with burning candle