LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di Edo State Police Command don arrest a 24-year-old Keke rider, Akpan Confidence, wey been use him Keke to rob and rape one female passenger.
Di female wey be student for university for di state been hire di Keke make e carry her go Ugbor area towards Airport road around 8PM on July 23rd, 2021.
As dem dey go, Confidence come follow another road talk say, di oda ones no too good before he comot cutlass talk say he go slaughter di girl, bury her if she no gree sleep with am.
Confidence been drag her go rape her for one uncompleted building, collect her money and iPhone too before he run leave her for inside bush.
EFCC don arrest 2 people wey thief N21.5 million wey dey meant for cancer patient wey later die
When police arrest Confidence around Sapele road for Benin city on Monday, August 9th he talk say he regret wetin he do.
Spokesperson of di State Police Command, SP Bello Kontongs, talk say di police go do investigation to see whether Confidence don commit any crime at all before.