LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) Kwara State Command, don arrest 32-year-old suspected serial burglar, Olaleke Tope, wey get better hand for di theifing of Plasma television sets.
Di spokesperson of di Corps for di state, Babawale Afolabi, been talk dis one for statement for Ilorin on Monday, August 16th. Di suspect na graduate of Business and Entrepreneur from di Ibrahim Babangida University, Lapai, Niger State.
Olaleke wey be papa of 2 children, dey live for No. 6 Ajala Ikan Road, Adewole Estate Ilorin. Na on August 10th, 2021 around 4PM dem arrest am unto say di person wey he thief from call.
[Photos] Mob don burn suspected thief for inside Delta State
Tope, di prime suspect don confirm say na him and one Madrid wey dey at large been break into di house carry 2 Plasma television on August 10th, 2021 around 4PM according to wetin Babawale talk.
As dem go check Tope house and shop, dem don see about 5 Plasma TV worth millions of Naira and other electronics too.