LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
One 87-year-older man, Amou Haji, never baff for 67 years now, over 25,000 days.
Di man dey fear water well well and since when he small he never naff unto some deep emotional traumas. Even though Amou no dey baff, he dey drink about 5 litres of water from one rusty tin.
Di Iranian man dey live alone near one village for Kerman Shah province. According to di villagers, Haji dey always dey dirty and he never baff because he dey fear say he go sick if he baff.
Doctors don comot live ladybird insect for man intestines
Di old man dey always chop rotten meat products and dead animals. He too like porcupine and to dey smoke him tobacco pipe. Sometimes sef, he dey smoke animal shit for him pipe.
India times follow talk say di man dey use fire trim him hair.